Thursday 24 April 2014

Hell set loose on a suspected ritaulist...


Better wahala happen for Saje area of Abeokuta, Ogun State yesterday, when some boys put fire for the body of one man wey them suspect say na ritualist,  una remenber say plenty plenty ritual den don dey comot for open, sake of say God don dey expose all of them, one by one, hmmm, if you be riytualist and you dey read this ogbonge gist, stop now o, before hell go catch up with you, even for this earth.


Emmm, we hear say the man no be that area him dey live, and dem burn the man around 6:35pm o. GTB hear say some boys been suspect them way, as he dey waka waka the street any how, eh, the guy cup full, wen e ask one school girl where he wan reach, na so he charm the school girl o. my people, na so God catch am o. one eyewitness, wey him name na Godwin, say the suspect been dey roam the street for some days before them come burn am to death by boys, the boys say the man spray perfume inside the girl’s face, say the thing pain the girl well well and she dey behave any how self, na so dem kill am o.

As if that one no do, GTB hear say for Ojuore side, of Ota, Ogun state, another ritualist been show face, but out of three men, two run away, the gist reach us say, dem put the womanfor booth of the car o, na so God catch them for that round about side for Ojuore inside holdup. My people, make we dey pray for God’s protection o, as we too must dey very cery careful o.

No comments:

Post a Comment